"Not Just Weight, The Silent Wounds Of Body Shaming"

For Mama Precious compound, children dey play,

but na the wahala wey dey fly for their mouth dey loud pass their laughter.

“See her yam leg!” one pikin shout.

Another one laugh, “Him nose bend like spoon.”

Dem dey laugh no be because e funny,

but because nobody don tell dem say words fit wound pass slap.

Tife waka pass the mango tree, her scarf tie tight wella

no be because of sun,

but make her ear no show.

Aunty don tell her before say, “You sure say na ear be this or satellite?”

Chinedu just dey keep quiet for class roll call,

him dey pray make teacher jump him name.

Why? Dem dey always talk say him voice “be like woman own.”

Inside many African houses,

we sabi how to chop better food,

but we no sabi mind our mouth.

“You too black.”

“Your eye dey sleep?”

“See your hand don shrink finish.”

We dey drop all these insults like groundnut for veranda

so easy,

so casual,

but e dey cut deep.

Dem go talk, “Na joke I dey joke, no vex.”

But when joke don turn wound, who go treat am?

We dey praise strong mind,

but we dey forget say even strong tree fit bend when wind blow too much.

So I dey ask,

Na so we go dey live?

We go continue dey use joke kill person self-esteem?

Dem teach us say make we endure,

As African person we be,

we no suppose cry.

But even lion dey feel pain.

We no go begin tell ourselves truth?

Say body shaming no be culture na cruelty dressed like tradition.

This story na for Tife,

na for Chinedu,

na for the girl wey her lips “too big,”

and for the boy wey dem dey yab say him leg bend.

Na for all the people wey dem don tell say dem body no good enough.

So today, I shout am loud

"BODY NA BODY."

"FACE NA FACE."

Beauty no get one shape or one colour.

Na many ways e dey shine.

Make we stop to laugh when we suppose listen.

Make we stop to wound when we suppose hug.

Say no to body shaming.

Say yes to love wey loud and clear.

See people well. Hear dem well. Feel dem well.

"Let this be more than story, let it be a mirror. So when next you wan talk, look am well. Because word no be stone, but e fit break heart."

"Not Just Weight, The Silent Wounds Of Body Sha...
At the end of the month, we give out prizes in 3 categories: Best Content, Top Engagers and
Most Engaged Content.
Best Content
We give out cash prizes to 7 people with the best insights in the past month. The 7 winners are picked
by an in-house selection process.
The winners are NOT picked from the leaderboards/rankings, we choose winners based on the quality, originality
and insightfulness of their content.
Top Engagers
For the Top Engagers Track, we award the top 3 people who engage the most with other user's content via
comments.
The winners are picked using the "Monthly Engagers" tab on the rankings page.
Most Engaged Content
The Most Engaged Content recognizes users whose content received the most engagement during the month.
We pick the top 3.
The winners are picked using the "Monthly Contributors" tab on the rankings page.
Here are a few other things to know for the Best Content track
1
Quality over Quantity — You stand a higher chance of winning by publishing a few really good insights across the entire month,
rather than a lot of low-quality, spammy posts.
2
Share original, authentic, and engaging content that clearly reflects your voice, thoughts, and opinions.
3
Avoid using AI to generate content—use it instead to correct grammar, improve flow, enhance structure, and boost clarity.
4
Explore audio content—high-quality audio insights can significantly boost your chances of standing out.
5
Use eye-catching cover images—if your content doesn't attract attention, it's less likely to be read or engaged with.
6
Share your content in your social circles to build engagement around it.
Contributor Rankings
The Contributor Rankings shows the Top 20 Contributors on TwoCents a monthly and all-time basis.
The all-time ranking is based on the Contributor Score, which is a measure of all the engagement and exposure a contributor's content receives.
The monthly score sums the score on all your insights in the past 30 days. The monthly and all-time scores are calcuated DIFFERENTLY.
This page also shows the top engagers on TwoCents — these are community members that have engaged the most with other user's content.
Contributor Score
Here is a list of metrics that are used to calcuate your contributor score, arranged from
the metric with the highest weighting, to the one with the lowest weighting.
4
Comments (excluding replies)
5
Upvotes
6
Views
1
Number of insights published
2
Subscriptions received
3
Tips received
Below is a list of badges on TwoCents and their designations.
Comments